Cholera outbreak in Nigeria 2024: How to avoid di disease wey dey kill pipo for Nigeria
Cholera don kill ova 30 pipo for Nigeria according to informate from Nigeria centre for disease control.
Di infection wey dey spread through contaminated food or water dey cause diarrhoea and severe dehydration.
NCDC say di disease don spread to 30 out of di 36 states for di kontri and affect 96 local goment areas.
Lagos State, di kontri commercial capital record 21 deaths and 401 suspected cases.
Di worst hit areas na Lagos Island, Kosofe, and Eti-Osa area of di state.
As tins be now, di places wia dis disease neva reach for Nigeria neva plenty.
Cholera na common and seasonal disease for Nigeria, e dey occur evri year mostly during di rainy season for areas wit poor sanitation.
Tori be say di first series of cholera outbreaks for Nigeria happun between 1970 and 1990.
Major epidemics also occur for 1992, 1995-1996, and 1997.
Between January and October 2010, di federal ministry of health bin report 37,289 cases and 1,434 deaths.
While for 2011 na total of 22,797 cases of cholera wit 728 deaths and case-fatality rate of 3.2% dem bin record .
NCDC also bin record 42,466 suspected cases including 830 deaths from 20 out of di 36 states from di beginning of 2018 to October 2018.
Dis na wetin you suppose know about Cholera wey go help you avoid am:
Cholera symptoms
- Watery poo wey go make you go toilet well-well
- Feeling sick or you dey sick
- Belle pain
- dehydration
How to avoid cholera
Dis na tins you fit do to help you to avoid to fall sick if you dey travel to areas wia cholera dey:
- Wash your hands wit soap and water regularly, especially afta you go toilet and before you prepare food or eat
- Only drink bottled water or tap water wey dem boil
- Brush your teeth wit bottled or boiled water
- No eat uncooked fruit and vegetables (including salads) wey you no wash wit bottled or boiled water and prepare yourself
- No eat seafood
- No use ice for your drinks
Vaccination for cholera
Vaccine dey for cholera, but most pipo no need am.
Dem dey give di vaccine drink. For adults, 2 doses (dem dey give dem 1 to 6 weeks apart)
E fit provide protection for up to 2 years.
Treatment for cholera
Di main treatment for cholera na to drink plenty of fluids, including rehydration solution.
Di rehydration solution na powder wey you go mix wit water to replace salts, sugars and minerals wey your bodi don lose through diarrhoea. Usually e dey available from pharmacies.
If you dey veri sick, you go need take treatment for hospital wia dem go teat you wit
- fluids through a vein
- antibiotics
link